As e be say terrorists don dey play dem music enta soja wey dey on duty and di ones wey don komot sotay dem dey kidnap and kpai dem, Senate don too change dem music as dem don play kasete make FG stop to dey rehabilitate bandits, terrorists or any kind bad krimina.
Na do Chairman of Senate Committee ontop Nigerian Army, Abdulaziz Musa Yar’Adua, nai move di motion say justice must be done but dem must see say e show to make confidence come back to Nigeria krimina justice system.
Naso all di lawmakers hree say any terrorist, bandit wey dey cus kasala make he face di law with no delay cus dis one nor be di time for soft hand hagain and dem go karey am to President Tinubu cus security for di kontri don get kleg.
