+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Govimet Dey Afta My Life – Peter Obi

Di Presidential candidate of Nigerian Democratic Congress (NDC), Peter Obi, say govimet dey make tins hard for am and dem dey still wan kpai am.

Na for interview with Chude Jideonwo nai Obi take say with di way tins dey go if dem kwatinue with di way dem dey threaten am dem fit kpai am anytime.

He say “Di way dem dey go, I fit nor even come out alive. I dey tell you anytin wey I take dey survive govimet dey spoil am.

“Everytin. so e possible say if dem get di opportunity, I nor go deg alive. Everyday nai I dey hear am cus wetin you tik say normal nor normal. Dem nor go come meet you face to face but you go see dem hand very clear.

“Di govimet dey hatak everybodi.dem dey hatak me wella, even wen na wetin dem suppose give me, notin go hapun

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM