Pipo wey come out alive from di Elite 5-Star Hostel, wey get 60 room for Amaokpala, near Federal Polytechnic, Oko, inside Orumba North LGA for Anambra State, don dey tok wetin hapun bifor di building fall on Sunday, July 26, wey two pipo die ontop.
One of di survival, Grace Nweke, say dat same Sunday around 10 for nite nai one pesin wey dey sell food for di building come send message to dem WhatsApp group day di wall of di building dey crak but pipo nor too take am serious until dem hear big sound and pipo come dey find where to put head.
Hakordin to Grace na January 2026 dem park enta di building and dem nor know wetin dey sup until later wey dem know say di pipo wey dey stay di hostel bifor dem tell dem to park cus di building nor good but cus of long throat di caretaker rent am to students wey nor know.
Di dead bodi wey don come out from na one guy and lady but na only di girl her friends don know. Dem say na Vivian Chinedum, she be baker and just graduate from di Department of Food Science and Technology from Federal Polytechnic, Oko. Bad tin say na still March 2026 she park enta di hostel.
