One chioma wey go sell her new born baby for Anambra State nai di Special Anti-Touting Squad Agency join with di state Ministry of Women Affairs and Social Welfare don katch her.
Na for Awada, Idemili North nai di tin take hapun but on Friday for SASA hufice nai Chioma confes say as she born finish nai Friday Prophetess Precious Unchenna, epp her sale di pikin.
Na 300k and house wey dem rent reach Chioma hand afta Prophetess Precious don give di pikin to anoda woman then she come take di remain balance.
But Precious say na epp she just dey epp Chioma cus dem porchu her from haux and tins really hard for her but why she give only 300k to Chioma from di N2.9m, she dey tok go here say she rent haux for di girl.
As mata be di mama wey sell her baby and di prophetess dey for state Ministry of Women Affairs to do more investigation on where di pikin dey and how to find am.
