One US policy advisory and lobbying firm, Von Batten-Montague-York, say President Bola Tinubu, don use millions of dollars take cover di drug kase wey dem say he get, so dat di records nor go come out and he dey form saint outside.
Na for X on Tuesday night nai di firm take post say all dos tok wey Tinubu dey say he nor dey stop anybodi to bring do record na heavy lie cus wetin he own legal team dey show for di ongoing Freedom of Information Act (FOIA) case dey difren.
Dem say Tinubu petition di court and go tok with di Federal Bureau of Investigation (FBI) and Drug Enforcement Administration (DEA) all in di name to make dem nor release di records.
