+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Hares Woman Wey Dey Run Gun Market For Agbor

Police hand don touch one 28 years woman wey her name na Happiness Clifford, for Agbor cus her hand dey inside gun market for di area.

Na thru info wey operatives of Special Anti-Kidnapping Unit (SAKU) for Ubulu-Uku, nai dem take hares Happiness and wey dem dey search di place, na inside bucket dem see 10 live cartridges.

All dis dey hapun for Ika South and na di woman wey dem hares, her husband Clifford Okoro, nai be di oga of di cartel. Police dey find am ro hares and dem still dey work to know where di guns dey go.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM