The Supreme Court don throw way the appeal wen Atiku Abubakar, presidential candidate of the Peoples Democratic Party (PDP) file against President Muhammadu Buhari based on d result of d February 23rd presidential election.
The apex court dismiss the appeal yesterday after dem don hear Atiku suit against Buhari victory for the presidential election petition tribunal.
D seven-man panel of the court come talk say dem go give the reasons for the judgement later later.
Meanwhile
APC chairmo wen be Adams Oshomole don hail the judges den he come say make Nigerians support the current administration and also helep to move the nation forward.
Whereas
Peter Obi vice wen be presidential candidate of the PDP during the election don thank Nigerians, he come still talk say the whole electoral process dey all about Naija and the future.