Naija inflation rate don climb go one 30-month high, as e rise more go 14.23 percent for d month of October and dis one na the latest figures wen show from the National Bureau of Statistics (NBS).
The report wen dem publish for the website of the bureau show say the new inflation rate dey 0.52 percent points higher than the rate wen dem record for September 2020 (13.71 per cent).
The figure rise by 1.54 percent between September and October and dis one show 0.06 percent rate higher than the rate wen e take rise between September and August (1.48 percent).