The House of Representatives don dey complain about the way wen workers for the health sector take dey vamuss comot from d country dem come say make the Federal Government do things wen go make d health workers stop to dey go other countries.
On Tuesday, the green chamber come tell the Ministry of Labour, Employment, and Productivity say make dem “review the salary, allowances, and welfare of Nigerian health workers.
The House come still tell the Ministry say make dem reason d expansion of the size of the medical practitioners for the country.