With d insecurity wen dey swell up anyhow for d country, the presidency still dey hold ground say d security situation for Naija don better well well now.
Femi Adesina, d Special Adviser on top Media and Publicity to President Muhammadu Buhari wen yarn for one interview on Sunday come talk say while d nation still get some way to go for d gbege against insecurity, he say dem don make better progress especially for the North East where boko haram badoo dem been hold strong.
Den concerning d steps wen dem dey talk based on d End SARS protest, Adesina say d president Muhammadu Buhari dey address all d demands wen d youths dem make.
He come talk say e go fit take a while to achieve their desire.