+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Government no get plan for fresh lockdown-Lai Mohammed

As Naija dey battle the second wave of the corona virus okpetu, Information minister Alhaji Lai Mohammed don talk say the Federal Government no get any plan to put fresh lockdown for d country.

Mohammed, wen voice for one conference for Lagos on Monday, come beg Nigerians say make dem follow all d protocols wen the Presidential Task Force on COVID-19 don give.

He come talk say d Federal Government no dey happy at all say Nigerians no dey obey the basic Covid-19 protocols of wearing face masks, say dem no dey practice social distancing, dem no dey gree wash hands, and say dem no dey avoid large gatherings.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM