Governor, Ifeanyi Okowa don tell authorities of Delta State Local Content Agency to dey transparent and say make dem dey follow d law even as dem carry out their operations so dat dem go fit do wetin dem suppose do.
The governor give the charge on Thursday for Asaba when he dey inaugurate the Director-General of the agency, Mr. Morris Idiovwa.
Even as he dey tell the director-general to dey transparent and to also focus on the goals of the agency, he come talk say na local content nia be the value wen companies or industries carry go national and sub-national economies.