+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

JAMB Go Bring 2024 Exam Results Today

Students wey don already write Unified Tertiary Matriculation Exams, UTME dey wait for dem result, Registrar of Joint Admission and Matriculation Board, Prof. Ishaq Oloyede say dem go start to dey bring out di results today.

For information wey di board send go give tori pipo for Abuja yesterday, dem say dem go get press briefing today and tok on issues wey concern di exam.

According to di Head of Public Relations for JAMB, Fabian Benjamin, say di resin wey make dem nor quick bring out di results na cus of tins like NIN, biometrics join with some kind woruworu way inside di exam.

While di ones wey first write dey wait for dem result anoda part of student out of the 1.9 million pipo wey enrol JAMB go finish dem paper today, Monday.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM