+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

E Go Reach Teree Weeks Bifor Line Go Komot From Filling Station – IPMAN

E dey show for some place say fuel no dey as price of petrol don go up and di tin don dey use style dey enta oda side of di kontri.

For weekend some state for North dey sell fuel for N900 and naso line long yakpa for filling station.

As Nigeria National Petroleum Company Limited, NNPCL, see di way tins dey go nai dem come out yesterday say make pipo nor fear say fuel dey do kontri and e go last reach teree months bofir so vessel wey dem dey expect go land.

But as mata come turn today, di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, IPMAN Public Relations Officer, Chinedu Ukadike, say dem nor go lie as dem nor get fuel to sell and if e nor dey naso line go dey long for petrol stataion.

Ukadike say hin for nack chest tok say na cus of di normal maintenace wey rifineries for Europe dey do nai make NNPCL nor fit get fuel.

Normally wey dis kind shortage don dey like dis e go reach two or teree weeks bifor tins go normal.

He come still say make di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority, NMDPRA, still dey try to quick renew licence of marketers cus that one na anoda problem for e own side.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM