+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

FG Insist Say Fuel Subsidy Don Go, Afta Document Of ASAP Leak

One report don dey waka every where for media houses say federal govimet don bring back fuel subsidy but di govimet still dey say na big lie notin like that dey hapun.

For document wey leak from di Accelerated Stabilization and Advancement Plan (ASAP) wey Finance Minister, Wale Edun karey go give President on Tuesday nai show say dem spend moni for fuel subsidy for 2024.

Dis ASAP, dem work na to check any challenge wey dey affect di kontri reform and do tins wey go epp di economy, na for di paper nai e show say di estimate wey dem put for fuel subsidy for 2024 na N5.4 trillion and that one sef dey big pass di N1.8trillon wey dem use for subsidy 2023.

But for very strong word wey FG tok thru di Special Adviser on Information and Strategy to President Tinubu on Thursday, Bayo Onanuga say make Nigeria pipo nor resin that document at all as dem don troway subsidy for toilet and e nor dey come back again.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM