+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ammunitions dey enter naija like water-Buhari

 

President Muhammadu Buhari don talk say undermining land borders wen dem close of recent, he say arms and ammunition still dey continue to dey flow enter d country like water.

According to one statement wen oga Buhari Special Adviser on top Media and Publicity, Femi Adesina drop, the President tender dis one for the Presidential Villa for Abuja.

He come talk say na d situation for Libya nia cause dis problem, say once the country continue to remain unstable, na so illegal arms and ammunition go continue to flow for the Sahel region of Africa.

Buhari come talk say Muammar Gadaffi tanda for power for Libya like say na him birthright for 42 years and say na so he recruit armed guards from different countries, when come las las escape with their weapons when them kpuff d Libyan okogan.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM