Govinor of Anambra State don say make all di private, govimet, and missionary skools wey dey for di state start to open every monday if dem nor wan hear long story.
Na for statement wey di Commissioner for Education, Prof. Ngozi Chuma-Udeh, bring on Thursday for Awka nai di Govo take day any skool wey nor folow dis order, di next tin wey dem go hear na say di skool don close.
As e dey, dem don already send di order go give all di skool for di state and na with immediate effect.
