Federal Medical Centre don bring dem own side of di tori of how di snake poison take kill di Abuja singer, Ifunanya Nwagene wey die on Saturday, January 31.
Pipo know di singer as Nanya and she sabi sing Soparano with Amemuso Choir but na on Saturday nai snake enta her haux go bite her, she cum go two hospital make dem remove di snake poison.
But FMC don come out tok say make pipo nor believe wetin dem hear from social media as di hospital try all dem best to save Nanya.
Dem say dem give her injection to flush her system, oxygen and even give her medicine to stop di poison of snake and dem don dey try to save her life wan rush her to ICU, wey her condition just worst.
FMC say dem try dem best to save her but she die so make pipo nor tok say na cus dem nor get snake medicine nai make di singer die.
