+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Army beg Naija piple for the farmers wen boko kill

The Defence Headquarters don beg Nigerians say make dem no dey discouraged becos of d way wen these boko boys take kpuff some rice farmers of recent for Borno State.

Coordinator Defence Media Operations, Major General John Enenche, wen beg d beg during the weekly media briefing with Defence Correspondents, come talk say undermining the recent killing of the farmers, the Armed Forces of Nigeria and other security agencies still dey fire down wit their major operations for across the country with all seriousness”

He come talk say very soon, the Boko Haram sect and all their wahala go end, say dis one wen dem dey do as dem take dey attack innocent and harmless people na way to take put fear for the mind of d people so dat their moral go dey high.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM