Policemen don take over di Peoples Democratic Party Secretariat on Monday cus of di National Executive Committee meeting wey dem suppose do today. Di police enter di seketaria to make sure say di NEC meeting for today nor hold cus di too much tension wey don dey ontop PDP dey increase everyday. Wetin one official wey dey di party tok be say, some staff enta inside di place but e nor tay nai police tell all of dem to come out and even tori pipo sef, police still drive dem komot from di seketaria.
We don recieve 110 letters for new party – INEC
The Independent National Electoral Commission (INEC) say dem don receive letters of intent from 110 associations wen want register as political parties. Na Mahmood Yakubu, INEC chairman, nia yarn dis one on Wednesday for one meeting wen he get with the media for he commission headquarters for Abuja. Yakubu come talk say wen those interested to register new political parties need to refer to the handbook wen contain the regulations and guidelines for political parties 2022 on.top the commission website.
Landmine explode for Imo state
One landmine explode for inside Eke Ubaheze Market Square for Awo-Idemili for Orsu LGA of Imo state on Tuesday, and ns ao e kpuff one person and den injure five others. According to report, the blast wen happen around 2:40pm, kpuff Ngozi Umeh, one trader from Ubaheze village. Locals claim say na two people nia denkwes, but d police confirm only one death. According to report, Henry Okoye, otota for the Imo police command, say dem dey suspect say na members of the proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB) and their armed wing, the Eastern Security Network (ESN) nia plant d landmine.
We Nor Give Extension To Kopa Wey Curse President Tinubu, NYSC
National Youth Service Corps (NYSC) don get anoda set of curse from pipo as di Rita Uguamaye wey dey serve for Lagos State say NYSC don give her extention to serve extra months bifor she pass out. Rita na one lady wey dey serve for Lagos come come online dey curse President Bola Tinubu say he nor dey try as hunger wan kill pipo for his time, wey she post di video finish for TikTok naso mata come full ground. Bifor pesin look, Rita say pipo don dey warn her to delete di video, why she go curse Lagos and President Tinubu, she come say na how e be, come tell Lagos pipo make dem nor vex. But yesterday nai anoda video come say NYSC give her 60 days extension but di Acting Director of Press and Public Relations fod NYSC, Carol Embu say wetin Rita dey tok nai big lie. Embu say di only pesin wey fit get extension for NYSC na di kopa wey don finish service year and nor be di one wey still dey serve. She say Rita na still kopa wey dey do her NYSC and dem nor fit give her extention until as nor be so NYSC style be.
NNPCL Ogas Use 5 Private Jet Fly To Rwanda For Retreat
For some time now na only gbasgbos from probing nai Nigeria National Petroleum Company Limited (NNPCL) ogas dem dey face, from the one of how dem spen moni to change Warri refinery, Port Harcourt own and now anoda mata of travel wey dem do to Rwanda. Now pressure don be like beans wey dey ontop pressure pot as new mata don come out say NNPCL hire 5 private jet take fly go executive retreat for Kigali di capital of Rwanda for two days event. Pipo wey di jet karey na di senior ogas, board members and di oga kpatakpata, Bayo Ojulari. Wetin insiders tok be say na one belong to Abdullahi Bashir Haske, nai get di jet and na still owner of Etihad Oilfield Services. That company na wetin NNPCL don put for black book cus dem price na die and di company sef EFCC dey investigate dem onto say dem dey own dem contactors. Di tori come still get am say pipo come dey vex dey tell Ojulari make he stop all di plan but he nor hear he still rent di private jet.
Memo leak show attack paln for Benue and Nassarawa
The Department of State Services (DSS) before now give security alert to Moses Gara, commander of Operation Whirl Stroke (OPWS), with the warning of planned attacks on top different communities for Benue and Nasarawa states. The memo wen leak wen carry May 13 as date show intelligence wen dey suggest say suspected Fulani militias dey prepare to strike as dem dey retaliate the alleged seizure of cows by the state government. The memo specifically list many communities wen dey at risk to include Yelewata, Mararaba, Vandikya, and border settlements between Benue and Nasarawa states. But undermining the warning, on June 13, gunmen carry out deadly attacks for Yelewata and Daudu, both of dem for Guma Local Government Area of Benue State and na more than 200 people, including internally displaced persons and farmers, nia kpeff for d attack wen dem call the third major attack for the area within a week. As part of response to the rising insecurity, Commander Moses Gara before now hold one high-level meeting for Makurdi with leaders of the Miyetti Allah Cattle Breeders’ Association of Nigeria (MACBAN) and Operation Whirl Stroke, when dem launch for 2018, include the military, police, and DSS, and dem set am up to gbege armed violence for the region.
Our foreign exchange reserve don rise – Gboyega Isiaka
The Chairman, House Committee on National Planning and Economic Development, Gboyega Nasir Isiaka say the country foreign exchange reserves don rise from $32.9 billion by the end of 2023 go more than $38.448 billion for June, 2025. Isiaka, member of the House of Representatives wen dey represent Yewa North/Imeko-Afon Federal Constituency of Ogun State, wen yarn for one during one media meeting for Abeokuta, Ogun State capital on Sunday come hail President Bola Ahmed Tinubu for him bold step wen e come to reforming the nation economy. He come still talk say the federal fiscal shortage don reduce well well and he say die one dey signal stronger financial discipline and improved economic management.
Police don arrest 22 suspects for wedding killing
The police command for Plateau say their operatives don arrest 22 suspects based on the report wey dey play say dem get hand for the killing of 12 wedding guests for the state. On Friday, 12 people legoo after one gang set fire for one commercial bus wen dey filled with wedding guests wen been dey travel from Zaria, Kaduna dey go Quan Pan LGA for Plateau for the ceremony. President Bola Ahmed Tinubu come direct Caleb Mutfwang, d governor of Plateau state to take action and say make he get to the root of the issue. Wen Alfred Alabo, Plateau police otota come dey yarn for inside one statement, he come talk say dem resuse 21 travellers and say dem don carry dem go hospital for medical treatment.
Wetin Dey Pastor Paul Adefarasin Hand Na Crime – Police
Pastor Paul Adefarasin of House on di Rock Church wey karey hinsef go report for Lagos State Police Command cus of di viral video wey he own sometin wey resemble gun dey face one content guy, police don free am. Na Benjamin Hundeyin, di Public Relations Officer nai tok am for X say afta many kwestun and answa nai dem allow di pastor go but investigation for di mata never finish. Dem say di tin wey dem think say na gun nor be real gun but na stunt gun wey dem nor even dey use for riot and that one na crime. So Hundeyin say even as police don give pastor Paul bail, dem never stop for investigation and any update, kontri pipo go hear am.
Pastor Paul Adefarasin Dey With Police Afta Video Trend
Senior pastor Paul Adefarasin of House on di Rock Church, don karey hinsef go meet police cus dem say he point sumtin like gun for one man. On June 6, 2025, nai one guy see motor start to video am, naso pastor whinde down warn di guy make he nor try am film am again di guy come dey beg. Afta di video trend online nai di pastor say he nor use any gun face di guy wey video am. Na cus of di mata nai make Lagos State Police tokpesin Benjamin Hundeyin say “No bodi big pass di law and dem don invite Pastor Paul Adefarasin to dem headkwatas make he come tok why he karey wetin be like gun dey point pesin and dey even drive motor wey nor dey registered. Police come say dem go update pipo about how di investigation dey go.