Many pipo don dey tok am for many years say e go beta if govimet for reduce di cost of governance and that one go be right step to take epp di kontri but some say no, na chopping all di way. Di tok don give reach Abia State as di House of Majority Leader, […]
We Nor Want Abure Again– NLC
Some workers don dey vex karey provocation go di National Seketaria of Labour Party as di Nigeria Labour Congress don match go say dem must to sack Abure. NLC say e dey be like say na wayo dey turn for Abure eye cus hin dey plan to do convention for end of dis month without […]
Keke Rider Dey Luk For im Johnthomus Afta Shoemaker Touch Am For Ghana
With all di wahala of pio johnthomus wey dey lost any how for Kasoa di Central region for Ghana, many pesin don dey wonder how dem fit take stop am. Just last week one 47 years man wey dey ride keke wey Ghana pipo dey call Pragya, pipo say hin gbola lost as he shake […]
Okuama Fire: Shame Suppose Dey Catch Army Pipo, Lawyer Farotimi
Lawyer and human rights activist, Dele Farotimi and Femi Falana two human right lawyers don tok how e be dem concerning di hass wey army burn afta 16 sojas die for Okuama village. On Sunday for inside X nai Farotimi he say e nor gud as di sojas die but burning di village nor be […]
Bag Of Pure Water Don Turn 450, Pure Water Producers
Di tins wey sachet water business pipo take dey produce water don dey very expensive even as other business pipo dey cry say every tin don dear for di kontri. Producers wey dey for Warri, Effurun, and Jeddo on Friday go strike for teree days so dat dem go strategize way to epp dem business. […]
Army Burn Okuama Village Afta Jaguda Kill 16 Sojas
Di village for Ughelli South wey one commanding officer, two majors, one captain, and twelve soldiers die on Saturday, on Sunday fire don descend burn am. Na 16 of di sojas nai die for Okuama as dem go dey do settle peace between Okuama and Okoloba communities before some youths wey bodi dey peper kill […]
Papa Knack Hin 9 Years Pikin Tik Say Na Wife
Police for Adamawa don arrest one man wey be 42 years cus of say hin go knack him 9 years girl pikin for nite tik say na e wife. As Shuaibu wife, Asmau Isa see wetin di husband don do to dem pikin nai she go police station go report di case. Police arrest papa […]
Oyo Ban Kprakpra Take Away Plate
E nor too tay wey Lagos State say dem nor wan dey see all dis kprakpra foam take away plate and plastic wey pipo dey use take buy food and package other tins for party. Oyo State naw don jump enta di challenge as di second state wey go folow for take away plate baning. […]
Succés Masra, Chad PM Wan Contest For President Seat
Prime Minister of Chad wey di military govimet put for di kontri affair Succés Masra, on Sunday say hin wan come out as president of di kontri. Him dey tok e mind afta 6 days wey General Mahamat Idriss Deby Itno say hin too wan be president. Masra na foma opposition leader wey run from […]
Foma Cote d’Ivoire President Wan Contest As President Again
Foma President of Cote d’Ivoire Laurent Gbagbo wey first get issue about for 2010 about election wey he nor gree cus dem win am, say hin go run again as president for di 2025 election. Gbagbo don first found one party wey be Ivorian Popular Front but pipo come kolet am from his hand wey […]