To make surr say everybodi sitdon for house nor go anywhere today Monday for Awka, Anambra State, gummen don go kill five pesin for Abatete, Abagana and Ukpo town. Like around 8/10am nai dem first take reach Abatete town down teree pesin, two vigilante and di President General of di town but di PG dey for hospital dey battle between life and death. Then for Abagana and Ukpo communities dem shoot one vigilante and one okada man die. Tokpesin of Anambra Command , DSP, Tochukwu Ikenga, say de never know di real mata as tok never straight but he men don reach ground to gada all info.
Delta Assembly Change Delta State University of Science and Technology Ozoro To Southern Delta
Delta State House of Assembly don passed amendment bill to change di name of University of Science and Technology, Ozoro, to Southern Delta University, Ozoro. Na for dem plenary on Wednesday for Asaba nai dem decide am and dey wait for di signature of Govinor Sheriff Oborevwori to seal am. Na Govinor Oborevwori first send letter to di Assembly on Tuesday make dem resin di mata and sharply make di legislature do first, second and third reading for di mata make e turn to law afta Emeka Nwaobi, di Majority Leader karey di motion for head and Charles Emetulu, wey dey rep Ndokwa West (PDP) folow support. Speaker Dennis Guwor say dis move go epp di skool as dem change am to Southern Delta University, Ozoro cus new faculties go dey and other tins go folow.
EFCC Ask Court To Bail Co-defendants Of Yahaha Bello
Two pesin wey dem name join for di case of foma Kogi State Govinor, Yahaya Bello, nai EFCC tell court to give dem administrative bail as dem reach court today Thursday. Di counsel of EFCC, Jamiu Agoro nai tell Justice Maryann Anenih of Abuja High Court say Umar Oricha and Abdusalami Hudu wey dem out fresh charges for dem head join Bello dem wan free dem. He say di 30 days period wey dem give Bello to come court to show hinsef still dey and never expire so make dem allow Oricha and Hudu get bail first till that time.
you go pay fine if you break anti-open grazing law- Warri South LG
Livestock farmers for Warri South Local Government Area, wen go against the Delta State Anti-Open Grazing Law, go fit end up to pay fine of N100,000.00 (One Hundred Thousand Naira) as the Warri South Local Government Special Taskforce for Security, wen Comr. Ofoyeju Izuagie dey head d enforcement of the law in Warri South. Them reach d decision to begin enforcement of the law for one large security meeting wen hold for the Warri South Council Main Secretariat for Warri. Na d Chairman of Warri South Local Government Area, Comr. Weyinmi Isaac Agbateyiniro nia take charge of d meeting wen representatives of different security agencies, Arewa community for Warri and other critical stakeholders attend. Warri South Council Supervisor for Agriculture, Hon. Amiwe Pinnick Mofe, wen yarn wit news people for Warri on Wednesday November 13, come talk say dem no go allow livestock like malu, goat and dog, to just dey Waka for major roads and streets for Warri.
Boundary wahala dey fight peace for Naija – Gov. Sheriff
The Delta State Governor, Sheriff Oborevwori, don talk say boundary issues dey work against peace, security and prosperity of communities for across the country. Oborevwori yarn dis one for d one-day workshop for the creation of platform for Naija coastal states and local government areas wen hold for d Unity Hall, Government House, Asaba. He come talk say na plenty people nia don denkwes becos of boundary gbege and den he come call on the National Boundary Commission and other stakeholders to work hard to settle boundary casala wen dey play among border communities for the country.
Govimet Don Porchu Students Wey Beat Skool Mate For FUG Enugu
Di 13 students wey gada drop wotowoto for SS1 day student for Federal Unity College, Enugu State nai Govimet don suspend afta di video wey dem take dey flog di boy go viral on November 7th. For statement wey Minister of Education, Dr. Tunji Alausa thru hin Director of Press and Public Relations, Ministry of Education, Folashade Boriowo, bring on Wednesday nai say dem suspend di boys for teree weeks. Di minister say dem don set up disciplinary committee wey dey look di mata and go come out with dem report cus skool suppose be where pesin go learn and dey safe. Alausa come still say dem don already send law enforcement agent to go di skool cus of security and e go give dem enough time to check oda tins.
Taraba Pipo Say Dem Nor Fit Buy Pure Water N50 Again
Pipo wey dey stay Jalingo for Taraba State don dey beg di state govimet to call di chairman of Pure Water Producers Association and investigate wetin make water distribution companies for di state dey behave somehow. All na sake of say pipo don tire to dey buy one pure water for N50 and di wahala don too much. Dem say if dem compare di price for Jalingo to di one wey dey for Adamawa and Gombe where dem dey sell for a N20 or two for N50, di pipo say e reach make govimet come out mouth. As dem dey shout say govimet nor get regulatory bodi to check mate wetin dey hapun for pure water factory, even di pure water pipo say na cus fuel price too high nai make material to produce am come still go up.
Okpebholo Don Enta Seat As Govinor of Edo State
Winner of Edo State govirnorship election, Monday Okpebholo nai don officially enta as di Executive Governor of di State. Dem do di swearing-in ceremony for Samuel Ogbemudia Stadium for Benin and na di Chief Judge of the State, Justice Daniel Okungbowa nai swear am in as Govinor with di deputy Dennis Idahosa. As Okpebholo dey tok to di pipo afta di swearing-in, he say he go make sure say Edo get to di point where pipo go dey jealous dem cus of development. Even as dem do di ceremony e dey very clear say tins nor normal as foma Govinor, Godwin Obaseki no come to really karey di state affair give di pesin wey take over from am.
NAFDAC Destroy Millions Of Fake Wines, Spirits For Nasarawa
National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) enta wine shops for Maraba market, new Nyanya and Masaka wey dey for Nasarawa State, seize many fake products wey dey di market. Wetin NAFDAC post for X on Monday, na pinsure of different wines and spirits wey reach N41.2 million and all na fake. Dem say investigation dey on to know di pipo wey dey importer and produced dis fake wines. But NAFDAC don tell pipo to shine eye and let dem know if any fake drink dey around dem.
Kizz Daniel – Pano Tona ft. Adekunle Gold
Naija music star and top singer for Flyboy Inc.’s Kizz Daniel don shock him listeners with one new vibe wen he call “Pano Tona” This track dey follow him previous jam “Mahraba” for back. Kizz Daniel carry Adekunle Gold join body for this track and he con combine the skill of Philkeys , Blaise Beat and Reward Beats take produce this track.