+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Buhari administration na apology-Jega

Attahiru Jega, before before chairmo of the Independent National Electoral Commission (INEC), don talk say the administration of President Muhammadu Buhari na apology.

Wen Jega dey voice wit news people for one interview, he come talk say the current administration don perform below wetin plenty Nigerians been dey expect”.

Jega when serve as INEC chairmo for Naija from 2010 go reach 2015, remain the only INEC chairmo wen don take charge of two general elections for Naija, that is 2011 and 2015, when president Goodluck Jonathan lost to Buhari, and dis one make oga Jona the first sitting president to lose re-election.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM