Students of college of education for warri protest on Thursday against d alleged intimidation and oppression wen dem say dem dey receive from of management of the kians wen the provost Prof Mary Onire Edema dey lead.
The protesters when run one peaceful go crown and Kpoko FM office for along airport road come talk say some of the final year students neva still see their 100 level results, den dem come still complain about d increment of school fees without any formal notice.
The students come still talk say mago mago dey for the result wen dem get from their department and the ones wen d scholl display online.
Wen the school come dey react through their talk talk person, Vusi Enakarire, he come talk say d allegations no be true, he say d students neva see their result because them neva pay their school fees and so dem no go fit get access to d school online portal.
Den concerning the issue of increment for fees, Ms Enakarire, he come talk sagy wetin the students describe as increment for the school fees na the 5, 500 penalty wen dem dey tender for late payment and registration.
Students wen never see their results na because them never pay school fees from which year? Result of first semester no dey but dem fit bring result of second semester abi? The vusi wen talk am ask am whether e com out com hear wetin the provost talk and how the matter dy since on monday for the school?