+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fine Boi Jim Iyke don come back to film acting

Jim Iyke don give reason why he come back to acting. He talk say one nollywood production wey dem dey call Seven and A Half Dates bring am come back to the movie industry as he soji the script of the movie. He talk dis one after the news come out say the movie go soon show for Netflix. The movie go join other nollywood movie wey Netflix go show.

Meanwhile for Cinema the movie don make about 33 million naira. Dem release the movie for cinema on August 3, 2018. People wey act for inside na: Mercy Johnson, Sola Sobowale, Toyin Abraham, Bayray Mcnwizu, Frank Donga, Ali Nuhu, Akin Lewis, Jim Iyke, and Fathia Williams.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM