+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fire for Onitsha burn 40 buildings,kill woman and pikin join

Tori don show face say one woman and her pikin kpuff plus 40 tall buildings nai destroy for fire wey happen for Upper Iweka, Onitsha for inside Anambra state.

Over 500 shops wey lock nai the fire still burn along the Iweka street market wen lead to Ochanja and Menax market.

 

This okpetue happen wen one tanker wey carry fuel dey drive down from Zik’s roundabout wen be the end of Onitsha – Enugu expressway, loss control around Toronto Hospital con divert commot from the service lane.

The tanker head fall commot from the body, na so the fire take start to catch after the fuel pour for the area.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM