New light go start to shine for Delta State wey go touch di whole kontri as Ebenco refinery dey wan complete dem oil and gas local refinery wey dem build to epp reduce di cost of fuel.
Di refinery capacity na 30,000 barrel per day and na for Koko e dey even FG don clap for di work and say e go epp support local refinery, tiff of oil go reduce and even bunkery work go stop for Niger Delta.
Wey di Chairman and Chief Executive Officer of Ebenco Global Link Limited, Dr. Ebenezer Oluwagbemiga, dey tok about di refinery wey dem go finish dis year, he say e go bring down price of fuel and na di ever fes local refinery wey Nigeria don ever get.
