+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Naija death penalty wahala and social media bill palaver

The Nigeria Governors’ Forum don bounce the proposed death penalty for hate speech bill wen dey for the National Assembly.

Na yesterday nia the governors take yarn dis one for the end of their seventh meeting for Abuja wen d Vice-Chiarmo of the NGF and Governor of Sokoto State, Aminu Tambuwal take charge of.

Them come still talk say dem dey ready to conclude negotiations with labour unions concerning the implementation of the N30,000 minimum wage before the December 31 deadline.

Meanwhile

Shehu Sani one before before lawmaker from Kaduna central don talk na go nia our democracy dey so.

Sani download dis informate during one recent television program wen he dey yarn concerning the proposed social media bill.

He come talk say Nigerians need to stand up against any law wen go silence their opinion

Whereas

Femi Falana, human rights lawyer don talk say he go drag the federal government go court if them try am pass the bill enter law

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM