Di Senator wey dey represent Kebbi Central, Adamu Aliero, say di new terrorist group, Lakurawa wey dey disturb North-West nai military don porchu komot go Niger Republic.
Some weeks ago nai Nigeria military tok say one new group dey try cause gbege for di kontri but later other tok come say di Lakurawa group no be new one as dem don dey since 2018.
But wey Senator Aliero come dey tell tori pipo about di update of di mata on Friday for Abuja, he say na Chief of Defence Staff, Abubakar Badaru join other pipo nai put hand togeda porchu di terrorist group on Tuesday komot from Nigeria.
Aliero say di troop nor fit enta Niger Republic nai make dem stop for di border afta di group run but now military get to colabo with Niger so that dem fit stop Lakurawa forever.