+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No dey travel for night-FRSC

The Corps Marshal of the Federal Road Safety Corps (FRSC), Boboye Oyeyemi, don advise fleet operators, commercial drivers and private vehicle say make dem no dey travel for night.

Wen Mr. Oyeyemi dey yarn for one statement through the agency’ talk talk person, Bisi Kazeem on Sunday, he come dey complain about d rising cases of road accidents and d number of deaths wen dem dey record for night.

The FRSC oga come talk about one serious accident wen happen for January for Kabba, Kogi State, where two motor jam each other face to face.

He come talk say d accident happen becos one of the drivers dey sleep on top steering becos he don tire unto say body no be firewood.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM