+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Oil and gas industry for Naija nor dey grow well

The national assembly dey complain bitterly about the slow growth of the oil and gas industry for Nigeria.

When them dey yarn during one public hearing onto the passage of the P. I. B bill on Monday for Abuja, senate presidoo wey be Ahmed Lawan say need dey for them to develop and create beta strategies wey everybody go benefit from.

Meanwhile as him still dey talk about how the 9th senate need to put more effort to see say them pass the PIB bill, he come still let them no say if them pass this bill E go open up beta tins for the industry.

 

Still on still wen the minister of state for petroleum resources wen be Timipre Sylva dey yarn he come hail the lawmakers for their move. He come say he belief say them go soon reach beta agreement wen go make tins dey ok.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM