+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Onitsha Market Go Open On Monday, Govimet

Tins go normal for Ontisha main market, Anambra State, today Monday as di State Govinor, Chukwuma Soludo don give goahead make dem open traders shops and say security gi brekete.

Na for inside statement on Sunday wey di Commissioner for Information, Law Mefor, bring out nai he take tell pipo wey dey sell for Ontisha main market make dem go open dem shop on minday cus di one week shut down don finish.

Di govimet come say make pipo still shy dem eye to look so that bad pipo nor go cus gbege and any tin make dem hala 5111. And as traders dey go shop make teachers and civil servants find dem way to office or dem nor go see salary wey month end.

Why for papa and mama side, di govimet say make dem allow dem children to skool on Monday if not, govimet go punish di papa or mama wey nor gree.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM