Eye go turn one 30 years Adamu wey dey stay for Wuro-Ardo, Mubi North LGA inside Adamawa afta police finish investigation for he head cus of he 1 years step daughter wen he rape.
Mata say di mama wan go buy sumtin for supermarket, nai she karey pikin give di papa wey be barber to hold till she come back.
As she reach hass nai she see say di daughter dey komot blood from bodi, rush her go hospital nai ther dokitors confam say pesin don rape di pikin.
Na di mama karey mata reach Police hand, nai police sharply go arrest di papa.
Even police tru dem tokpesin for Adamawa, SP Suleiman Nguroje, don confam am say di rape hapun for on di 30 of April.
Police say afta investigation na straight to court nai Adamu go land make he go dance to di music wey he don start.