+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Jaguda Boys Dey Burn Market For Lagos

Pipo goods wey cost dem moni just dey burn dey go for Ile-Ekpo market wey dey for Lagos State as jaguda boys nor even allow fire service to go quech di fire.

Tori say na yesterday nite nai gbege start for di marker between some jaguda boys bifor you know dem don start to burn some pipo shop.

As e dey now some pipo don get serious wound for bodi and make police even enta sef to epp matas di jaguda boys nor gree.

Di time wey dis tori dey land, wetin cus di problem, and why dem set fire for di market never dey clear.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM