+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Don Hares Police Wey Kill Pesin For Effurun

Di police man, ASP Nuhu Usman, wey go kpai Mene Ogidi for Effurun on Sunday afta dem catch di supect with gun wey he wan waybill, dem don harest di police, send am from Asaba to Abuja.

Di hufica fess shoot Ogidi for leg afta he dey beg say na he friend for Sapele decive am, say he go tok, nai ASP Usman gun di 28 years man direct for head.

Naso di video come dey waka for X, na di mata come make di PPRO of Delta State Command, Bright Edafe, in tok on Tuesday, say dem don hares ASP Nuhu Usman cus he go hagais wetin dem law tok about shoot, even thou say na him lead di oda police to go catch Ogidi.

Edafe say di State Commissioner of Police, Yemi Oyeniyi, nor hapi with wetin hapun nai make dem hares am karey am send to Headkwata Abuja for discipline.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM