+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Palava

The Nigeria Police Force don talk say their operatives wen dem send to go arrest Senator Dino Melaye for him bonk no go comot from there until the Senator surrender himself for arrest and investigation.

The Police wen download dis informate yesterday come talk say Senator Dino Melaye dey wanted by the Police becos he jump comot from their motor becos he wan dodge arrest and also becos him and him jaguda dem shoot one Sergeant Danjuma Saliu for the month of July, 2018.

Wen d force’ Public Relations Officer, Jimoh Moshood come dey yarn for d Force Headquarters for Abuja, he come talk say dem no go comot from there until Melaye surrender himself for arrest and investigation.

One Washington-based group, International Strategic Studies Association ISSA, don talk say the death of one before before chief of Air Staff, Air Chief Marshal Alex Badeh, and one before before Chief of Administration of the Nigerian Army, Maj.-Gen. Idris Alkali, no be something wen just happen like dat.

According to reports, na one gang of youths wen dey protest for along Jos-Bauchi Road nia kpuff Alkali on September 3, while some badoo dem come kpuff Badeh for along the Abuja-Keffi Road on December 18.

ISSA, wen be one non-governmental organization wen dey involve for national and international security and strategic policy, talk for one special report dis past weekend say dem kpuff the two men to hide wetin dem describe as the pattern of corruption for the current military leadership for Naija.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM