+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Report say oga naked him hotel workers for warri

Mr. Kenneth Gbagi, former Minister of State for Education, Delta state

No be small matter nai play on Tuesday becos of d reports wen rotate come say d management of the Signatious Hotel for Warri, Delta State, treat four of their staffs anyhow.

According to d reports, the Chairmo of the hotel and before before Minister of State for Education, Mr. Kenneth Gbagi give order say make dem naked the workers wen be three women and one man kpatakpata.

As if that falling hand no reach, d ones wen dey snap dey snap and na so d ones wen dey video dey video too, dem come send d videos and d pictures put for social media.

police verdict

But like dis, activists and social media users don condemn d matter, dem come say make the state Commissioner of Police, Hafiz Inuwa, torchlight the issue and den arrest all d people wen involve for d matter.

Meanwhile Egba Ederoghene, the otota of the hotel don talk say him oga no get anything to do with this mata. He come talk say the people wen dey for the picture plan with other politicians to bring him oga down.

Three ladies wen the guy report say dem strip naked

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM