Before before vice presido Atiku Abubakar, don tell the federal government again to sell off the Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) and their refineries.
Mr Abubakar repeat the statement on Sunday as part of wetin he dey recommend to take reduce Naija high unemployment figures.
He make dis statement wen he dey react to one report wen show from Bloomberg Business on Saturday wen say Naija go soon get d highest unemployment rate for planet Earth, with more than 33 percent rate.