+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Senators say make national assembly shut down

Before Deputy Senate President Ike Ekweremadu

 

Based on say every dey para say the National Assembly neva gree stop the security situation wen dey worse for across Naija, two senators, before before Deputy Senate Presido, Ike Ekweremadu, and Kogi West senator, Smart Adeyemi don tell the National Assembly to shut down.

Them yarn dis one during one long debate on top one motion wen involve the activities of Boko Haram insurgents for three local governments for Niger State, dem come say Nigeria need to seek foreign help.

But wen senate presido Ahmed Lawan come dey yarn him own, he come talk say the legislature get important role to play during d time of crisis.

Wen deputy Senate Presido Ovie Omo Agege dey talk for d floor of the house, he come talk say need dey to invite d security chief to come clear the red chambers what’s up.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM