+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Spreading fake rumors fit land Naija for big kasala

Aisha Buhari wen be the wifey of President Muhamadu Buhari don warn Nigerians say spreading of fake news fit lead the country enter big kasala. The wifey of the president ball enter Naija on Sunday two days after one video spread like wide fire for social media, wey show say she dey binu say the “cabal” lock her out of the presidential villa.

Ontop of that one kind big rumor come dey play say President Buhari dey marry Sadiya Umar Farouq, wen be the minister of humanitarian affairs, on Friday.

Las las Aisha Buhari come yarn say she nor dey the country for long because na tradition for over 20years for her to escort her pikins go for long holidays.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM