+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

ULC say strike wey labour plan na Capital Fail

The United Labour Congress (ULC) don describe the strike wey labour plan once d deadline wen dem give federal government to take pay the new minimum wage give every civil servant pass, as capital fail.

For inside one statement, wen the ULC Presido, wen be Joe Ajaero, drop, he yarn say, ULC, nor go enter strike wen carry the real struggle of Nigerian workers.

But for another side, the meeting wey labour, and the Federal Government dey hold over the minimum wage matter, go still continue today, to see whether dem go fit reach agreement.

For the meeting, wen dem hold yesterday for Abuja, the Head of Service, wen be Mrs Folashade Yemi-Esan, yarn say, she get hope say, today meeting go bring beta result.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM