+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Waffarians roast three Omila for Warri South

Hand touch some omila wen go rob for Okumagba lay-out for the Warri south local government area of Delta state dis early mor mor.

The matter na say the guys wen reach six go rob but their goat come born nama wen hand touch three of them.

While dem roast two of them for Emebirhen junction, dem come cramp the last one wen be dey try escape and na for Ojabugbe junction dem come take roast that one.

This na wetin one of the eye witness get to talk on top d matter.

He come later advise our youths make dem find something do so that all these kind yeye matters no go continue to dey sup.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM