+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We go sack officers wen dey do kurukere matters

The Nigeria Customs Service (NCS) don promise say dem go sack officers when no go fit live wit d salary wen dem dey receive wen dey put hand for kurukere matters.

Na the comptroller-General of d NCS Hameed Ali, wen be retired colonel nia give the warning wen he dey decorate some officers of the service wen dem newly promote for Abuja.

He come give warning say make no officer wen dey for the service live above his or her salary if them desire to remain for service.

Ibrahim Magu wen be d acting chairmo of the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don talk say Naija and South Africa dey make plans to reach agreement on assets recovery and repatriation.

Na wen Magu dey yarn for the closing ceremony of the two-week capacity-building and mentorship programme for 10 officials of the Liberian Anti-Corruption Commission (LACC) wen shele for the EFCC Academy for Abuja nia he for take download dis informate.

Under the agreement, d South African government go return assets wen men gbanskele comot from d country go that way and na so we go return their own wen dey here too.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM