+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Naija Defence:We don kpuff Boko senior men

Naija Defence Headquarters don say their troops of Operation Lafiya Dole don kpuff top Boko Haram commanders during massive clearance operations wen take place for the Lake Chad Basin.

Wen defence otota, Major-General John Enenche dey yarn on Thursday for Abuja, he come talk say dem mod the commanders after troops for the Lake Chad Basin, locate their camps and where dem dey shock-in put.

Even as Enenche dey hail d security agencies for their efforts, he come talk say the army dey determined to protect the territorial integrity of Naija

Major Enenche come still tell Nigerians to dey support the army by to dey report criminal activities for their area.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM