+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Naija governors don ask IG to bring out guilty officers

Governors of the 36 states of the Naija don tell Mohammed Adamu, the inspector-general of police, to bring out the policemen wen dey responsible for the deaths of protesters for across the country.

Na since nia Nigerians don dey protest becos of the yeye way wen dem say the special anti-robbery squad (SARS) dey behave.

Protesters ball enter the streets dey demand for end to police brutality, meanwhile some of the protesters come clash with security operatives and dis one so come lead to the loss of lives.

Amnesty International say d people wen don kpuff don reach ten (10).

For one teleconference wen the Nigeria Governors’ Forum (NGF) hold on Thursday, them come talk say the IGP must produce the olokpa dem wen attack the protesters

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM