+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

90 billion pounds don enter UK hand for kukere waka

The United Kingdom (UK) dey receive about £90 billion wen people dey use kurukere way take dey move comot from Naija, Africa and countries for third world every year, and dis one na according to report wen show from Christian Erikson and Lionel Faull, anti-corruption advocates.

The advocates drop dis tatafo for one joint paper even as dem collabo with The Corner House; MacArthur Foundation and the Open Society Initiative for West Africa (OSIWA) run d matter.

Them say most of the pepper wen men dey move come dat way na from the third world, including Nigeria.

According to them, 87,000 illegal assets wen dey for the UK wen companies wen dem no know get dey for tax havens, while the values of properties wen people secretly get for the UK dey between 56 to 100 billion pounds, with 40 percent of these properties for the city of London.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM