One of Cameroon politician wey be mayor for Bamenda don die as dem see her deadi bodi for Nchoubuh junction with blood everywhere.
Di mayor na Joko Frida and na she be be di second deputy mayor of Bamenda 2. Dem say she dey come back from President Paul Biya’s documentary film projection from town, on October 26 but kidnaper tiff her for Savana Street wey her house dey.
Family pipo say dem don karey her deadi bodi go Bamenda Regional Hospital make dem go do rest.
Di way di woman die never clear but pipo dey suspect say di attack come from separatist group.