+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Kill Four Kidnappers For Abraka Railway

Police for Delta state don join hand with oda security kill four kidnapers wey dey hide for Abraka Railway.

‎Di police team and di oda security nai rush reach Abraka railway area early mormor on Tuesday bifor eye open close, shooting don dey hapun like Rambo film but di police dem gun down four of di kidnapers while di oda ones wey get gun wounds for bodi run.

‎According to di Police Public Relations Officer, for di State Command, SP Edafe Bright he say na Abraka Police Patrol Team join with hunters, vigilantes, and anti-cult pipo nai go di hideout afta dem get beta information about di kidnapers.

‎For di scene nai police see AK-47 gun wey di kidnapers dey use plus 13 rounds of live bullet.

‎Small investigation wey police don do show say one of di suspect wey die nai be di hand leader cus one pesin wey dem just free from di kidnapers tok say so.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM