As di biday celebration of Govinor Sheriff Oborevwori dey come on June 19th do pipo wey dey for Ibori Gold and Country Club for Asaba dey plan koret maiden edition og Govinor Cup Invitation Golf Tournament to mark di biday.
Captain of di club, Chief Patrick Ukah, say na 300 pipo wey sabi play golf and go compete for N3m, plus young players and oda high pipo from different part of di kontri nai go dey for di one week tournament.
Ukah, na di Director General of Delta State Capital Territory Development Agency too, na for Asaba on Monday nai he take tok say di tournament no be just ordinary one cus na function to celebrate Govinor Oborevwori.
With di plenty activities wey don dey ground, oga Ukah come still say di Govinor Cup go follow di IGCC Captain’s Day Tournament wey dem just finish join with Govinor two years in office celebration.