+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Pipeline Surveillance For Urhobo Land Suppose Be For Urhobo, Group Tell FG

Urhobo Renaissance Group (URG) don dey tell Federal Govimet and NNPCL make dem dey follow wetin law tok and give contract of pipeline surveillance for Urhobo land to Urhobo pikin.

‎Dem send their message thru statement wey di group National Chairman, Olorogun Akpoyibo Clifford Erhiegueke, sign, say make nobodi think say Urhobo pipo dey fear cus nor bodi get right to craze of dem wan use madness way.

‎D group say as FG dey deny Urhobo dem opportunity e nor good as e even go against di international treaties law wey dey protect pipo wey come from oil producing communities.

‎Olorogun Akpoyibo say Urhobo get right to know about anything wey dey hapun for dem land and even make decision, with wetin law tok and funny sef di pipeline dey dem backyard and na dem for look am well, so make dem give di surveillance contract to Urhobo pikin.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM